fbpx
December 23, 2024

Fraudster don enter prison because hin impersonate Nollywood actor, Bolanle Ninalowo

fraudster-impersonate-bolanle-ninalowo

This na another tori, one fraudster, Omoghan Destiny Igbinosa, dey sentenced to two years imprisonment because hin impersonate Nollywood thespian, Ninalowo Bolanle.

Di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC, na hin bring this tori come outside for inside statement on Monday, February 20, 2023.

Justice Okon Abang of di Federal High Court wey dey Warri, Delta State convict and sentence Igbinosa, to prison on one count charge of impersonation. Dem tok say di fraudster impersonate to be di nollywood actor Bolanle Ninalowo.

FOR MORE NEWS: “Your life no go ever be di same” – Cubana Chief Priest don pledges to sponsor Yusuf Alabi through university

According to parts of di statement, hin offense dey contrary to section 22 (2) (b) (i) of di Cybercrime (Prohibition Prevention, etc.) Act 2015 and punishable under section 22(2) (b) (IV) of the same Act”.

Justice Abang convict and sentenced Igbinosa to two years imprisonment or a fine of One Million Naira. Also, di defendant go forfeit di sum of $2,235.00 and hin mobile phone to di Federal Government of Nigeria.

You fit go read di full tori…READ MORE