fbpx
December 22, 2024

Actress, Funke Akindele and ex-husband, JJC skillz don fuel reconciliation rumor

funke-akindele-reconciliation-rumour

Rumour don spread about di reconciliation of Popular Nollywood actress, Funke Akindele and her estranged husband, JJC Skillz, e be like say dem don make peace months after dia separation.

Remember say after JJC announce dia seperation in June 2022, di two of dem unfollow dia sef on top Instagram.

JJC, inside post on top hin Instagram page for di early hours of Thursday, June 30, announce say him and di award-winning actress don separate.

According to am, dem don dey deal with marital issues for two years, and hin dey forced to move out of dia matrimonial home three months before di announcement.

 

FOR MORE NEWS: “Anambra student Ejikeme Mmesoma forge her UTME result” – JAMB spokesperson don reveal

 

Also, as Funke dey tok about wetin lead to di separation from her ex-husband, JJC Skillz, Funke, on her part, yarn say her husband dreams and visions for dia marriage no sync again.

“Well, the truth is our dreams and vision of what our marriage should be just no longer aligned. And efforts to make it work all fell on deaf ears, so why hang around?” Na wetin she tok be dat.

However, a recent check on their pages show say dem don follow dia sef back on top di platform.

Di gesture don bring excitement from fans of di former couple wey dey rooting for dem to reconcile, come back together.

You fit go read di tori of Funke Akindele reconciliation rumour…READ MORE