fbpx
December 22, 2024

Gov Mohammed don approve recruitment of 1,684 workers

governor-mohammed-approve-recruitment

Bauchi State governor, Senator Bala Abdulkadir Mohammed don approve di recruitment of 1,684 secondary school teachers, extension workers and staff of di state-owned Aminu Saleh College of Education, Azare.

Dis matter dey disclosed to journalists for Bauchi by di State Head of Civil Service, Alhaji Yahuza Adamu Haruna. Hin add say di approval follow di lifting of embargo of employment for di state civil service by Governor Mohammed for hin inaugural address on May 29.

 

FOR MORE NEWS: Police Arrest One-chance Robbers for Lagos

 

Also, di Head of Service yarn say out of di 1,684 wey dem go employ, a total of 1,000 teachers for English Language, mathematics, biology, chemistry, physics and ICT na hin dem approve to be employed.

Alhaji Adamu add say 150 staff na hin dem go employ for di Aminu Saleh College of Education, Azare. Also, 206 extension workers and farm managers go dey employed for di state Ministry of Agriculture in fulfilment of di Governor promise during di launch of di 2023 farming season and sales of fertilizer for Azare.

However, Adamu warn applicants make dem dey careful of fraudsters. In addition, hin assure dem say di recruitment process go dey monitored by the government and security agents in order to identify wey fit capitalise on am to defraud unsuspecting applicants.

You fit go read di tori as Governor Mohammed approve recruitment…READ MORE