fbpx
May 14, 2024

Police Arrest One-chance Robbers for Lagos

RRS-arrest-one-chance-gangs-for-lagos

Operatives of di Rapid Response Squad, RRS don arrest three suspected members of one-chance gang wey dey operate along Oshodi–Gbagada Expressway, Lagos.

According to statement issued by Lagos Police Spokesman, SP Benjamin Hundeyin, di suspects bin abandon dia operational vehicle, one Suzuki mini bus wey pipo know as ‘korope’ for Gbagada area of Oshodi-Oke along Gbagada–Oshodi Expressway, on April 14, 2023 when RRS operatives catch dem as dem try to drop off one victim.

 

FOR MORE NEW: “Respect my wife privacy” – Davido don give serious warning to blogger

 

Investigations reveal say di suspects bin earlier hijack di operational vehicle for gunpoint wey dey Ketu bus stop, Lagos-Badagry Expressway, Ojo sometime in February and di incident bin dey reported for Ijanikin Police Divisional Headquarters.

Di suspects na 24-year-old Wale Ajayi, 26-year-old Abideen Saka and 29-year-old Oliseh Sunday aka Bobwhiskey. Na dem police arrest for dia hideout following weeks of intensive investigation.

You fit go read di tori as RRS arrest one-chance gang..READ MORE