fbpx
May 19, 2024

Harass APC voters, face full wrath Of law, Omo-Agege warn political parties for Delta state

0

Deputy Senate President, of diAll Progressives Congress, APC, and gubernatorial candidate for Delta state, Senator Ovie Omo-Agege, don warn political parties wey dey plan to harass APC voters on di 2023 elections go face di full wrath of di law.

Senator Omo-Agege, bin lead APC from one ward-to-anoda ward campaigning to Warri South Local Council on Friday, 16th December.

U FIT ALSO READ Omo-Agege don carry campaign go Itsekiri waterways, e say now be di time to liberate Delta

Hin don promise voters say dem go provide adequate security, wey go protect all APC supporters and voters on election day.

Omo Agege don assure APC voters say, “ nobody fit scare dem, Nobody fit molest dem, APC don readi to provide adequate security for everybody. And by di grace of God, we go win.”

Senator Omo-Agege tok say di era of “ one local strongmen,” running away with election materials don over. Na BVAS age we dey now and those wey dey plan to chase away APC voters comot dat day, no room for dat kind thing dat day for dem.

Hin don promise to reactivate Warri port and ensure say di Warri City Stadium work again, revive Warri industrial park, and attract various companies wey don leave di city come back to Warri again.

Hin don promise to increase student bursaries, empower women, create job opportunities for di youths and provide adequate security for di State.

APC Chairmo, Warri South, Mario Onwume, don tell di pipol say, make dem take dia destiny into dia hands and stop di PDP from wining on di election day.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *