fbpx
December 22, 2024

Adamawa election: ‘I bin dey under pressure’ – Suspended REC, Yunusa Ari don break silence

hudu-yunusa-ari-don-break-silence-on-di-election-saga

Weeks after di Adamawa governorship election saga, Hudu Yunusa Ari don break silence. Di suspended Resident Electoral Commissioner, yarn say hin declare Aishatu Dahiru, wey dey known as Binani of di All Progressives Congress, APC, winner because security pressure.

Remember say di Independent National Electoral Commission, INEC, suspend Yunusa Ari after di illegal declaration of Binani winner, contrary to di Electoral Act.

But, INEC enter di matter declare Ahmadu Fintiri of di Peoples Democratic Party as di authentic winner of di Adamawa State election after dem follow due process.

 

FOR MORE NEWS: U-17 AFCON: Make your country proud – Peseiro charge Golden Eaglets

 

Fintiri polled 430,861 votes to defeat Binani of APC.

Also, INEC ask di inspector-General of Police and necessary security agencies make dem find Yunusa Ari prosecute am.

After di whole saga, nobody don hear from or see Yunusa Ari.

You fit go read di tori as Hudu Yunusa Ari don break silence…READ MORE