fbpx
December 22, 2024

Presidential election: INEC chairman threatens lawsuit after PDP’s rigging allegation

inec-chairman-threatens-lawsuit-over-claims-of-rigging-election-

Di Chairman of di Independent National Electoral Commission, INEC, Prof Mahmood Yakubu yarn say di allegation wey tok say hin rig di presidential election fit lead to lawsuit.

Na di electoral chief issue reply give di Peoples Democratic Party, PDP. Dis na after di leadership, on Friday, ask am make hin resign.

Also, di opposition charge di police and di Department of State Services, DSS. Hin tell dem make dem investigate di chairman over alleged manipulation of election results.

A statement by Yakubu Press Secretary, Rotimi Oyekanmi yarn say di call dey misplaced and hin challenge di PDP say make dem prove dia claims for court.

However, di spokesperson wonder why di party no provide evidence to back up di allegations.

Oyekanmi yarn say PDP no give evidence of how Yakubu sabotaged di uploading and transmission of results from polling units.

FOR MORE NEWS: INEC fault judgment wey permit Temporary Voters Card for polls

Also, di aide maintain say di INEC no dey rig elections, dis na one of di reason why di allegation wey tok say hin rig di presidential election fit lead to lawsuit.

Hin stress di tok say di Bimodal Voter Accreditation System, BVAS don ensure di integrity of di electoral process.

For inside statement, Oyekanmi remind PDP say to make dat kain allegations against di person of di INEC Chairman dey actionable.

You fit go read di full tori…READ MORE