fbpx
May 4, 2024

INEC fault judgment wey permit Temporary Voters Card for polls

INEC-fault-judgment-on-temporary-voters-card-for-polls

Di Independent National Electoral Commission on Thursday night yarn say dem go appeal di court judgment, wey order say two Nigerians with Temporary Voters Card go dey allowed to vote during di March 18, 2023 governorship and Houses of Assembly elections.

Also, di spokesperson for INEC Chairman, Rotimi Oyekanmi, na hin tokj am on Thursday.

According to am, “Di Independent National Electoral Commission don collect copy of di judgment wey dey delivered today by di Federal High Court, Abuja Division. However, di commission dey take immediate steps to appeal against di judgement of di trial court.”

In addition, reports tok say di  Federal High Court for Abuja, on Thursday,  order INEC  make dem allow di use of Temporary Voter Cards for di governorship and Houses of Assembly elections wey dem shift go March 18.

FOR MORE NEWS: Afenifere dey drag INEC for disobeying electoral guidelines

Justice Obiora Egwuatu drop di order as hin dey deliver judgment on suit wey dey filed by two aggrieved Nigerians, Kofoworola Olusegun and Wilson Allwell wey pray say make court allow dem vote with dia Temporary Voters Card , as INEC fail to issue them with dia Permanent Voter Cards before dem close process.

Justice Egwuatu yarn say say hin make di order because of say those two Nigerians dey duly registered and captured for INEC database.

Di court stand dia ground say no portion of both di 1999 Constitution and di Electoral Act, states say na only Permanent Voter Cards pipo fit use vote.

You fit go read di tori…READ MORE