Mobile phones, photographic devices dey prohibited from voting cubicle – INEC
Di Independent National Electoral Commission INEC don warn voters say di use of mobile phones or any photographic device inside di voting cubicle to take pictures of di party wey dem cast dia votes for dey prohibited.
Na during news programme on top channels Television na hin National Commissioner and Chairman of INEC Voter Education and Publicity Committee, Barrister Festus Okoye announce di information.
FOR MORE NEWS: Nigerians Decide 2023: D-Day don dey here
He yarn say any body wey dem catch go enter jail upon prosecution.
According to am, “Nobody go dey allowed to take his or her phone to di voting cubicle. INEC don sound di alarm say mobile phones dey prohibited.
“Officials of di ICPC, EFCC and security agencies go dey on ground to monitor and ensure that say di law in that respect no dey violated.”
You fit go read di full tori…READ MORE