fbpx
December 22, 2024

Presidential poll: INEC still continue results collation despite protests

inec-results-collation-despite-protests

Di Independent National Electoral Commission don ignore di demands by various stakeholders, including political parties, to pause di ongoing collation and declaration of di results of Saturday presidential and National Assembly elections over allegations of electoral manipulation and compromise. INEC still continue di  results collation despite protests from parties.

As e be so, di Peoples Democratic Party and Labour Party for di National Collation Centre for Abuja on Monday protest di failure of di commission to ask officials make dem upload di results for di INEC portal from di polling units.

All of dem complain about di magu magu wey dem feel say e dey for di results of di polls. Also, na dis matter make dem ask di electoral commission make hin stop di proceedings for di collation centre and address dia complaints. However, INEC no gree, hin still continue di results collation despite di protests.

However, following di refusal of INEC Chairman, Mahood Yakubu, to do wetin di parties want, some opposition parties on Monday stage walkout during di announcement of results for di  National Collation Centre, International Conference Centre, Abuja.

FOR MORE NEWS:BREAKING: Peter Obi don win Tinubu for Lagos 

Di PDP wey query di commission na hin lead di walkout. Hin drop hin observation over alleged differences for di results wey dem release and di failure to upload di election results inside portal for public view.

Also, di PDP agent, Senator Dino Melaye, lead di opposition parties comot for di collation centre in protest against Yakubu refusal to acknowledge and act on dia observations and demand.

The other parties included the Action Alliance, African Democratic Congress and Social Democratic Party.

You fit go see di full tori…READ MORE