fbpx
September 30, 2024

“Women no dey post dia men online because other men go stop to give them money” – Influencer, Pamilerin don tok

influencer-pamilerin-tok-about-women-wey-o-dey-post-dia-man-online

One Twitter influencer, Pamilerin Adegoke, don share di reason why some women no dey show off dia partners online on social media.

Taking to di microblogging platform, Influencer Pamilerin yarn say some women no dey post dia lovers online because e go discourage other men from giving them money.

According to am, such women know say if dem make dia relationship public, dem go lose di favour of dia numerous benefactors online.

FOR MORE NEWS: Naira redesign: People will beg for Buhari’s return – Okon Lagos

Na wetin hin write fo di tweet be this;

“The reason You don’t post your man is because other men will stop giving you money!! BUSINESS WOMAN😂.

Hin tweet don spark plenty different comments online. On top di matter, plenty ladies come out counter hin stance. They explain say dem dey keep dia relationships private for  plenty reasons.

Read comments below,

@manaakeey write, “Sometimes, we no trust di man and so we no want scandals. Date silently, chop breakfast silently”

@thonia_Aroh wrote, “Or maybe because we no  want too much pipo to dey ask us questions incase he serves us cold breakfast…
Chop breakfast silently and recover silently…”

You fit go read di full tori…READ MORE