Inter Milan don sign France forward, Thuram
On Saturday, di Serie A club announce say Inter Milan don sign French international striker Marcus Thuram
According to report, di 1998 World Cup winner Lilian Thuram, also 25-year-old, bin sign five-year deal with last season Champions League finalists wey worth 6.5 million euros ($7.1 million) a season.
Inter secure hin services on di back of hin most successful season for Bundesliga side Borussia Moenchengladbach wey hin score 13 goals — hin become free agent at the end of di campaign.
FOR MORE NEWS: Shettima Advise North West Leader Make Dem Unite, Support Tinubu On Insecurity
Thuram go play up front alongside Lautaro Martinez after hin pick di country of hin birth rather than Paris Saint-Germain.
Dem born am for Parma where hin papa play for five seasons, and hin win di UEFA Cup and Italian Cup for 1999 as part of a star-studded outfit wey featured Italian icons Gianluigi Buffon and Fabio Cannavaro.
Thuram fit need to battle with Romelu Lukaku to get hin place for Inter starting line-up, as di Belgium striker dey in discussions to stay for Milan despite say hin loan from Chelsea dey end dis week.
You fit go read more of dis tori as Inter Milan sign Thuram…READ MORE