fbpx
April 27, 2024

Lagos set up big viewing centre for Nigeria vs South Africa match for AFCON

super-eagles-semi-finals-clash-south-africa

Ahead of di Super Eagles African Cup of Nations semi-finals clash with South Africa today, Lagos State Government don set up one mega viewing centre for Mobolaji Johnson Arena for Onikan.

Di viewing centre dey part of 25 others wey dey scattered all over di state. Dis na to encourage residents make dem enjoy di best African football showpiece. E be like that since di competition start for January 13 for Cote’D’Ivoire.

Di match with Bafana Bafana for Stade de la Paix for Bouake na di fourth time wey di two teams dey meet for di tournament, with di Eagles don win di three previous games.

Kick-off time na 6 pm.

Also, Commissioner for Information and Strategy for di state, Gbenga Omotoso, talk for one statement on Tuesday. Hin say e dey important for fans to watch di match as Lagos get di largest base of di team’s supporters.

“Lagos, wey be di sports capital and di base of di largest supporters of di Super Eagles, Governor Babajide Sanwo-Olu, deem am fit to provide opportunity for all fans make dem watch di match.

 

FOR MORE NEWS: Tinubu don return from France, call emergency meeting on food security.

 

Also, Mr Governor express hope say di national team go triumph for di match. And this because di team don show capacity and technical know-how to win,” Omotosho yarn.

Apart from di Mega Viewing Centre for Onikan, other centres dey for Agege Stadium, Abesan Sports Centre, Alimosho LGA Secretariat, Agbado-Oke Odo, Local Council Development Area, LCDA, Secretariat, L.A. Primary School, Layeni, Ajeromi-Ifelodun, Anglican Primary School, Aradagun, Badagry.

Others include New Road Primary School, Ajegunle, Femi Gbajabiamila Mini Stadium, Coker-Aguda, Surulere, Epe Recreation Centre. Sprite Court, Festac, Igando-Ikotun LCDA Secretariat, Onisabe of Igbobi’s Palace, Jibowu, Alajede’s Palace. Ijede, Oba’s Palace, Ijegun, Ikorodu Town Hall, APC Party Secretariat, Ketu.

You fit go read di tori of Super Eagles semi-finals clash South Africa…READ MORE