fbpx
December 22, 2024

Davido logistics manager, Isreal DMW, don drag crossdresser James Brown

isreal-dmw-drag-james-brown

Davido logistics manager, Isreal DMW, don drag crossdresser James Brown after wtching hin recent video.

Tunde Ednut share video of di crossdresser as hin dey rock pink gown for occasion and hin bin dey follow Tumi Agbaje tok.

Inside di video, James Brown as usual address himself as di princess of Africa and hin try to display hin ‘princessly’ vibes and act like woman.

However, di video make Isreal DMW vex, dat one immediately enter di comment section of di post to blast James Brown.

 

FOR MORE NEWS: “Life!” – Video from veteran actor, Olu Jacob 80th birthday stir emotions

 

He threaten di self-acclaimed princess of Africa say make hin do like that whenever hin come Benin city.

“Just come and do this rubbish in Benin city. We dey wait”, Na wetin Isreal write on top Instagram be dis.

Hin post however spark controversy on top social media as some pipo drum support for am while others slam am for threatening James Brown.

You fit go read di tori as Isreal DMW drag James Brown…READ MORE