fbpx
April 29, 2024

Lagos not be Igboland, we be visitors —Iwuanyanwu

Iwuanyanwu-visit-igbo-leaders

President General of apex Igbo socio-cultural organization, Ohanaeze Ndigbo, Dr. Emmanuel Iwuanyanwu, dey Lagos for a three-day visit and hin go meet with Igbo leaders and Governor Babajide Sanwo-Olu to address issues affecting Igbo for di economic capital of di country.

Inside interview after one of di engagements with Igbo leaders for Ikoyi, on Wednesday, he tok on issues around hin emergence as Ohanaeze leader, hin agenda for Igbo, di blowing wind of insecurity for di South-East and how di Federal Government fit arrest am among others.

On issues surrounding hin election as Ohanaeze leader yarn say some months ago hin bin dey elected leader of all Igbo, wey be di President General of Ohanaeze Ndigbo. Frankly speaking, at over 80 years, na very difficult thing for am to accept, although hin see say hin pipo dey very passionate about him serving dem.

 

FOR MORE NEWS: Chelsea agree €22m deal for Pulisic transfer as Okeke sign contract with Man City

 

All di leaders come meet am express dia support and confidence in am. Also, all di five governors of di South-East follow tell am say dem dey with am.

In addition, seven presidents of Ohanaeze for various states – Rivers, Delta, Imo, Abia, Enugu, Anambra and Ebonyi come too. Dem make am see say hin no get choice.

However, hin wife and children bin no want make hin accept am. But, hin convince dem.

You fit go read di tori as Iwuanyanwu visit Igbo leaders…READ MORE