fbpx
December 23, 2024

“Iyanya no go like my actions” – Boyfriend of lady wey catch singer, Iyanya attention for Davido concert don tok

iyanya-no-go-like-my-actions

Di young man wey hin girlfriend catch di attention of popular Nigerian singer, Iyanya, for Davido Timeless concert, don come out tok hin mind. “Iyanya no go like my actions” Na wetin hin write for tweet be dat.

Remember say Iyanya, wey be one of di guest artists for di concert wey hold for Lagos on Sunday, April 23, bin enter Twitter to recount how di lady catch hin eye inside di crowd and hin ask di lady make she contact am.

“One fineeee girl been Dey eye me yesterday @davido Timeless Concert. I had to focus on the job, so this morning I come remember 😂😂 if you are that fine girl report yourself now under this tweet, you wanted to confuse me ha,” Na wetin hin write on top Twitter be dat.

 

FOR MORE NEWS: “She bin dey eye me” – Iyanya trace fine girl wey hin meet for Davido concert

 

Inside another tweet, di “Ur Waist” crooner reveal say hin don see di lady. And hin express excitement as hin see her. Also, hin share one photo of di lady and he write, “Update: e be like we don see the girl 😍😍”.

However, e appears say di lady boyfriend no like di singer gesture towards hin woman, and he don enter Twitter to call am out.

As di matter be now, hin ask Iyanya make hin take down hin tweets about hin girlfriend. In addition, hin threaten to take action if Iyanya no remove am.

“A friend of mine called my attention to seeing Iyanya posting my girl’s picture on the internet. I thought it was a joke. Iyanya, with all due respect, can you take this down? “Iyanya no go like my actions”” Na wetin hin write for Twitter.

You fit go read di tori…READ MORE