fbpx
September 28, 2024

Jasmine na my lovely daughter, Mr Ibu wife na hin tok this one after reconciliation with her husband

jasmine-na-my-daughter-ibu-wife-reconcilation

Following her reconciliation, with her husband, di wife of John Okafor better known as Mr Ibu, Stella Maris don change mouth for all di things wey she don tok before about hin daughter, Jasmine Okafor.

On Saturday, Mrs Ibu claim say her husband dey have affair with Jasmine, and she reveal say di girl no be hin biological daughter.

However, following dia reconciliation, di mother of three, Mr Ibu wife don make U-turn, for instagram live session with Daddy Freeze, Stella Maris describe Jasmine as her daughter, wey also be her husband daughter.

FOR MORE NEWS: “I dey suffer for my marriage, Jasmine na my husband girlfriend no be daughter” – Mr. Ibu wife dey cry out for help

Also, she tendered apology to Jasmine for di false allegations wey she put for her head.

For inside video wey reporters post, di couple bin wear di same and dem dey smile. Mr Ibu and Stella look all loved-up and dem just dey tease theirself.

Di Instagram blogger reveal say di couple don settle di misunderstanding wey dem bin get for police station and Mr Ibu don go back house to hin wife.

To avoid future fights, dem make Jasmine and Mr Ibu Wife di manager of Mr Ibu social media pages, Stella get only small idea on how to manage the platform.

Also, dem instruct Jasmine say make she always dey take permission from hin wife, Stella and Mr Ibu must not go Jasmine house again say hin wan go stay there.

You fit go read di full tori...READ MORE