fbpx
May 18, 2024

“Dey Patient”! Jehovah Witnesses go Resume Larger Gathering with 696 Assemblies Across Nigeria

2023 Dey Patient Regional Convention

Like play like play, e don nearly reach three years wey Jehovah Witnesses don stop larger convention on top Covid-19 wey shake the whole world but tori wey dey reach now don confirm say everything don set for this year regional convention wey the tittle be “Dey Patient!” wey go happen for 696 Assembly ground across Naija.

According Olusegun Eroyemi, wey be the National spokesman for Jehovah Witness  for Naija, he talk say, Jehovah Witnesses for Naija dey happy well well for the opportunity to meet dia spiritual family again for the big facilities,” nah wetin he yarn be this inside the statement wey hin circulate for the di 2023 Dey Patient regional convention series wey go start for August.

Also, hin yarn say, na online dem bin dey do these larger assemblies since di outbreak of di COVID-19 pandemic.

According to Eroyemi, although Jehovah Witnesses for Nigeria don resume meetings for dia Kingdom Halls since April 2022, but di larger assembly facilities still dey under lock.

Also, hin give assurance say arrangements dey ground to ensure say di recommended safety protocols dey for all 23 Assembly Halls across di Kontri.

Afolabi Odeyemi, wey be Regional spokesman for Jehovah Witnesses, talk say, Ota for Ogun State, Ilesa for Osun State, amongst others places don dey kampe to host di first set of “Dey Patient!” Regional conventions for Nigeria.

He yarn say,  Prior to 2019, dry seasons for these cities always dey colorful as Jehovah Witnesses go filling hotels and restaurants as dey attend dia annual conventions for di various Assembly Halls across Nigeria.

But for 2020, corona virus scatter the tradition as Witnesses cancel dia in-person events throughout di world and dem kon dey do dia convention programs as virtual events in more than 500 languages.

Beginning first week in August, 2023, Jehovah Witnesses go resume dia larger gatherings, dem go bring di tradition back to Ota.

 

FOR MORE NEWS: Court grant group permission to observe Emefiele trial

 

Odeyemi add join say, as much as dem love di comfort wey virtual conventions carry, where everybody go sit down for him palour dey enjoy the program but nothing fit replace the togetherness and jolificate wey dey Larger Assembly. The online conventions really make sense as millions gather for the program all over the world which prevent our dear brothers and Sisters even from untimely death wey corona virus fit cause. Now, time don reach make we go see ourselves again for these large gatherings.

In addition, hin talk say some 6,000 conventions go hold worldwide as part of di 2023 “Dey Patient!” Convention series wey don start outside Nigeria from January 7, 2023.

Odeyemi  still talk say in Nigeria alone, more than 320 conventions go take place for 39 host cities. From Friday through Sunday, the convention go touch light di quality of patience, why we need am, using wetin dey happen now explain wetin scripture talk.

Also, dem go perform live baptism for Saturday morning session and a pre-recorded drama wey go featured for Saturday and Sunday afternoon sessions.

Hin stress am say di convention dey open to everybody even those wey no be Jehovah witnesses, nobody go ask you to pay kobo for entrance fee.

He kon add join am say, if you dey find more information on di program or to find other convention Area and dates, no waste time abeg, please go to jw.org and find you way reach the “About Us” tab.”