fbpx
April 28, 2024

Appeal Court Judge, Justice Ikyegh, Wey Be 65, Don Die

justice-ikyegh-don-kpai

Dem talk say Justice Ikyegh don kpai, e be like say na Justice Maurice Ikpambese, wey be Chief Judge for Benue state, announce am as dem do one event for Makurdi. Even though im family never yan anything official about im death, dem talk say e collapse when e dey make call for house, and im family try revive am but e no work.

Dem talk say dem con carry am go Benue State University Teaching Hospital (BSUTH), Makurdi, where doctors confam say e don waka.

 

FOR MORE NEWS: Naira Scarcity Worry Abuja: ATMs No Fit Give Cash

 

Justice Ikyegh, wey be 65 years old, na person wey sabi work well-well and get correct decisions. E just enta list of 22 Justices for Court of Appeal wey Federal Judicial Service Commission (FJSC) shortlist. Dem carry the list go National Judicial Council (NJC) make dem consider am for promotion to apex court from North Central, on reserve basis.

Justice Ikyegh don kpai, You fit go read di tori….READ MORE