fbpx
December 22, 2024

Kaduna beggars don disappear as Naira scarcity continue

kaduna-beggars-don-disappear-because-of-cash-scarcity-

Beggars along di popular Kano Road, Kaduna Central Market, and some elderly foreign nationals with dia children for di popular Ahmadu Bello Way don disappear. Dis na pipo wey dey always beg for charity money. Na dis cash currency scarcity na hin make di Kaduna beggars disappear.

Although in 2021/2022, di Kaduna State Government bin build one permanent place for beggars so dat dem go comot for streets, buy plenty of dem complain say dem hidden from di public or pipo wey go wan give dem gifts.

However, because of dat matter, dem comot from dat apartments for Kano road, Ahmadu Bello Way, Makarfi Plaza and some notable places.

Also, following di Naira redesign policy of di Federal Government, plenty beggars, including some Nigeriens, no dey dia dey beg again.

One of di beggars, Mallam Nasir Idris, yarn say unlike before wery hin go get over N3,000 daily, now all di customers dey ask for account number and hin no get.

FOR MORE NEWS: Naira redesign: Kaduna churches don lose millions as tithes, offerings reduce

Also, Isah Jibril, one beggar for Taiwo road wey relocated go di permanent abode wey government build tarn say for two weeks hin neva make N200.

According to am , some good Samaritans dey bring food for dem in di morning or evening.

He lament say life dey hard, and he pray make God make di hardship to to soft thing.

You fit go read di full tori…READ MORE