fbpx
May 2, 2024

Naira redesign: Kaduna churches don lose millions as tithes, offerings reduce

tithes-and-offerings-don-reduce

Church tithes and offerings don continue to reduce following di scarcity of new notes and di inability to transfer money from banks due to network problem.

Some churches for Kaduna don see tithes and offering figures reduce as members dey cry over di difficulty to get transport money to dia worship places.

For Mountain of Fire and Miracles Ministries, North Central 2 region Barnawa, di pastor of di church, Dr. Sunday Owolabi, complain of poor offerings due to scarcity of money and hin pray with seriousness for di change of our leaders.

Another pastor for one of di generational churches, Pastor John David, yarn say hin receive between N1.2 million and N2.5 million as tithes and offerings before,   but now e don reduce to between N20,000 and N50,000 because of di cash crunch wey dey di kontri.

FOR MORE NEWS: “Where did you get the money?” – Man don query hin girlfriend wey buy iPhone for herself

He lament say dem neva pay domestic staff salaries for January because di church neva  get any tangible amount since di cash policy start.

Also, for Dunamis Church, Television Kaduna, di Assembly Pastor, John Moses,yarn say di tithes and offerings no be di only thing wey dey reduce, but members dey reduce too.

According to am, most members dey complain about transport money to church, hunger and other serious issues.

You fit go read di full tori…READ MORE