fbpx
December 23, 2024

Singer, Kcee and wife celebrate 13th wedding anniversary with cute video

kcee-celebrate-wedding-anniversary

Popular Nigerian singer, Kingsley Chinweike Okonkwo, wey dey known as Kcee, and hin wife, Ijeoma, dey celebrate dia 13th wedding anniversary today, April 26.

Ijeoma, wey tie di knot with di indigenous singer for 2010, take to her official Instagram page to celebrate di milestone.

She post cute video of dem as dem dey do photoshoot for studio and she thank God for preserving dia marriage.

Also, di couple wear matching black outfits inside di video as dem play and laugh together during di photoshoot.

Ijeoma write,

“13 years of GOD’S GRACE…

GOD to you be all the GLORY

Happy anniversary to us 💖💖

 

FOR MORE NEWS: “Something wey dey sweet like sugar” – Actress Anita Joseph reply pipo wey say marriage na scam, she share tips

 

Fans and followers of di couple don rush go di comment section to celebrate dem on dia anniversary.

Also, e neva too tey wey Kcee open up on why hin bond with hin brother, E-Money still remain strong.

Di singer yarn say him and E-Money dey always support dia sef. Dis na wetin hin talk about di relationship between him and hin brother for interview with The Nation.

In addition, hin yarn say dem no dey argue. And women matter neva cause wahala for dem before. Hin tok say if no be so, dat one for don put strain on dia relationship.

You fit go read di tori as Kcee celebrate wedding anniversary with hin wife…READ MORE