fbpx
December 22, 2024

“I Am Not the One Who Said Your Parents Should Be Unlucky” MC Oluomo’s Son, King Westt, don lash Peter Obi Supporters

king-westt-lash-supporters

King Westt, son of di Chairman of Lagos Parks and Garages, Musiliu Akisanya wey dey known as MC Oluomo don lash out to Obi supporters. Dis na as dem drag am for campaigning for APC presidential candidate, Tinubu.

While taking to hin Instagram story, MC Oluomo son tell dem say make dem continue to dey curse am as e no affect hin account or reduce Tinubu vote.

As King Westt dey lash out to Obi supporters, King Westt yarn say no be him be di reason why dia parents dey unfortunate.

“Make una curse from today till tomorrow e no dey remove 5 naira from my account and e no dey reduce the vote wey tinubu get. No be me tell una parents make them dey unfortunate”.

Meanwhile, di Federal High Court don kicked against INEC to involve di NURTW chairman, Lagos Chapter, MC Oluomo inside di distribution of election material.

FOR MORE NEWS: INEC don pledge to announce elections results fast

Di union chairman don request make di electoral umpire contract di distribution of materials to am for Lagos ahead of di 2023 presidential elections.

Justice Chukwujekwu Aneke on Monday 20th February give order wey prohibit di Independent National Electoral Commission (INEC) from enlisting di services of Musiliu Akinsanya, alias MC Oluomo to distribute election materials for di state.

Also, di court grant “order of interlocutory injunction wey Labour Party and five others file. Dis na to stop di Independent National Electoral Commission of Nigeria (defendant/respondent), from taking any steps or further steps to engage or appointment or approve di appointment of Musiliu Akinsanya, wey dey known as MC Oluomo-led Lagos State Parks Management Committe.

In additition, Even di commercial bus drivers dey prohibited from distributing 2023 election materials and personnel for Lagos State pending di hearing and determination of di substantive suit.”

You fit go read di full git….READ MORE