‘Tinubu must be sworn in, Obi dey ask for di impossible’ — LP faction
Di Lamidi Apapa faction of di Labour Party, LP don distance himself from di calls for an interim government and di agitations say make dem no swear-in President-elect, Bola Tinubu, on May 29, pending di determination of di petitions before di presidential election tribunal.
Also, di Labour Party faction yarn say swearing in of Tinubu “fit no get any impact on di ongoing legal tussle on di presidential election involving dia party, APC and INEC.”
Inside statement on Wednesday, the faction spokesman, Abayomi Arabambi, declare say di Electoral Act and the Constitution of Nigeria no give room for vacuum, “so whether di President-elect dey sworn in or not, right dey to remove am legally if dem find out say hin no dey duly elected.”
Arabambi remember how di court remove Chris Ngige and confirm Peter Obi as di governor of Anambra in 2003.
FOR MORE NEWS: Nigeria dey invest heavily in youths – Buhari
Citing sections 136 and 146 of di constitution, Arabambi yarn say only death and permanent incapacity na hin fit stop President-elect from being sworn in.
Di LP factional spokesman underline di word say , “Wetin Peter Obi dey cry for no dey supported by di law.”
He maintain say “refusal to swear in Tinubu as President go create vacuum for di system.
You fit go read di tori as Lamidi LP faction distance himself…READ MORE