fbpx
May 3, 2024

CBN don drop update on ‘BVN expiry date’

bvn-no-get-expiry-date

Di Central Bank of Nigeria don explain say di Bank Verification Number, BVN, no get expiry date contrary to claims wey dey make round.

Ina addition, di apex bank explanation dey come amid speculations wey tok say di BVN get ten years lifespan.

Debunking di claims on Wednesday, di CBN acting Director Corporate Communications Department, Dr Isa AbdulMumin give update. Hin yarn say once dem capture customer biometrics, enroll am inside database of NIBSS, di BVN go stay there for life, e no get expiry date.”

 

FOR MORE NEWS: ‘Tinubu must be sworn in, Obi dey ask for di impossible’ — LP faction

 

He explain say di Regulatory Framework for BVN issued by CBN in 2021 need make customers update dia records on di conditions wey dey inside di document.

According to wetin hin tok, Nigerians wey dey captured on BVN no need to panic but dem fit continue to use dia unique identifiers.

CBN, with di Nigeria Inter-Bank Settlement System (NIBSS), launch di BVN project on 14th February, 2014, to capture di identity of all banks’ customers.

According to Godwin Emefiele for recent engagement, Nigerians with BVN rise to 57 million.

You fit go read di tori…READ MORE