fbpx
December 22, 2024

Nigerian puff puff na di best wey I don eat – Malala

Malala-describe-puff-puff-as-amazing

Nobel laureate, Malala Yousafza, don express her satisfaction with Nigerian foods and culture, she describe di Kontri puff puff as amazing and di best wey she don eat.

Malala yarn dis one as she dey tok for interview with Channels Television on Friday.

Di nobel laureate tok say she eat Nigerian puff puff just before her speech for di United Nations. She add say di puff dey “amazing.”

Malala  yarn say she dey travel so much around di world and every place be like home. For me, she feel like say she be citizen.

Also, she yarn say we suppose dey celebrate each other cultures, traditions and enjoy di food. In addition, she yarn say she love jollof rice, plantain, and di food here.

Na so she explain how she take chop di puff puff when hungry bin catch her. And she bin get like five minutes. So, as she eat one puff puff, e sweet well well for her mouth. Dat one na hin make her tok say na di best thing we she take before di speech.

 

FOR MORE NEWS: Davido logistics manager, Isreal DMW, don drag crossdresser James Brown

 

You fit remember say in 2012, Malala bin collect gun bullet for head head by Taliban militants, wey bin dey enforce ban on girl-child education.

But, the girl child-education advocate deliver powerful speech for UN on July 12, 2013 to mark her 16th birthday.

Also, di UN go later declare July 12 ‘Malala Day’ in 2014 — in honour of her advocacy and support for girl-child education across di world.

Malala visit Nigeria dis week, where she meet with Vice President Kashim Shettima.

She called on political leaders to invest more in girl-child education.

You fit go read di tori see as Malala describe puff puff as amazing…READ MORE