fbpx
May 18, 2024

Hollywood shut down as actors go on strike

Hollywood-actors-start-strike

Di Hollywood actors’ union start to strike for midnight Thursday, after di negotiations to reach a new contract with production studios end without agreement.

Actors go join writers for di first industry-wide walkout for 63 years. Also, effectively all di giant movie and television business go dey on hold.

At 0701 GMT, di Screen Actors Guild (SAG-AFTRA), representing around 160,000 movie and television actors, twee black picture alongside di message: “12:01 a.m. PT That’s a wrap!”

SAG-AFTRA bin issue strike order after last-ditch talk with studios over di reduced pay and di threat wey artificial intelligence dey bring. Dia meeting end without any deal.

SAG-AFTRA president Fran Drescher tell a press conference, following di union board unanimous vote to strike say if dem no stand tall now, all of dem go enter trouble,

Hin tok say dem dey enter trouble small small and dem fit even dey replaced by machines and big business.

 

FOR MORE NEWS: Nigerian puff puff na di best wey I don eat – Malala

 

In addition, writers don already spent 11 weeks dey protest outside di headquarters of di likes of Disney and Netflix, after dia demands for better pay no dey granted.

Movie studios don start to reshuffle dia calendars, and if di strikes drag on, major film releases fit dey postponed too.

Also, Drescher tell AFP say  SAG-AFTRA bin dey “duped” into extending negotiations for two weeks by studios wey bin wan promote dia movies.

You fit go read di tori see as Hollywood actors start strike..READ MORE