Burkina Faso, Mali, and Niger don kpake commot from ECOWAS.
Di military regimes for Burkina Faso, Mali, and Niger don talk say dem dey waka commot from di Economic Community of West African States, ECOWAS. Dem talk say ECOWAS don turn threat to member states. But ECOWAS Commission talk say dem dey ready for “negotiated solution” with the three countries.
Presidency, on dia own, yan say di three countries no dey technically ECOWAS members again since dem dey on suspension. Di leaders of di three Sahel nations yan for statement say e be “sovereign decision” to waka commot from ECOWAS “sharp sharp”.
Dem dey struggle with jihadist violence and poverty, and e don cause wahala between dem and ECOWAS since coups happun for Niger last July, Burkina Faso for 2022, and Mali for 2020.
Even though dem three countries be original members of di bloc since 1975, ECOWAS suspend dem and put heavy sanctions on Niger and Mali as di bloc dey try push for quick return of civilian governments with elections.
Di leaders yan say di sanctions dey “irrational and unacceptable” as dem don decide to control dia own destiny, especially after di coups wey remove civilian administrations.
FOR MORE NEWS: AFCON 2023: CAF don pick Super Eagles striker, Osimhen for drug test.
For recent times, di three nations don dey stand gidigba for dia decisions and join hand as “Alliance of Sahel States”. Di leaders talk say di 15-member ECOWAS, “under di influence of foreign powers,” don betray di principles wey dem start with and don become threat to member states and di people.
Dem accuse di grouping say e no help dem tackle jihadists, wey first enter Mali for 2012 and come enter Burkina Faso and Niger. France, under pressure from di military regimes, don waka remove ambassadors and troops, and Russia don waka fill di gap military and politically.
You fit go read di tori see why Burkinafaso,Mali commot from ECOWAS…READ MORE