fbpx
May 3, 2024

Angel Smith Blast Women Wey No Like Friends Call Dia Husband Name

angel-talk-about-married-women

Reality star, Angel Smith, talk about married women wey no like make their husband’s female friends call am by im name. She yan say for di discussion about di correct titles for married friends’ husbands, some people talk say make dem call dem “Sir” or other respectful term, but Angel talk say e no make sense.

She dey talk say make people call dia spouses by di names wey dem dey known for. Also, make di women focus on important matter, especially wit di current wahala wey dey di country.

 

FOR MORE NEWS: Burkina Faso, Mali, and Niger don kpake commot from ECOWAS.

 

Angel Smith talk say she go like make her friends continue to call her husband by di name wey people sabi am before dem marry.

Somebody for di discussion talk say if pesin call her husband by im name, she go first slap di pesin, dem go con fight and unfriend each other. Angel respond say some women dey marry con dey mad, say “Mrs” na im be dia identity. She come yan say, “Wetin I go call my friend husband? Sir? Or uncle? If I slap you and am, maybe we go call am conqueror, champion, igwe 2 pac.”

For anoda post, she talk say she go look di cultural differences between di different generations. However, she no fit call her friend husband “daddy” except na joke.

You fit go read di tori see  wetin Angel talk about married women…READ MORE