fbpx
April 28, 2024

N585m scandal: Sack Betta Edu, save Nigeria democracy – Adeyanju tell Tinubu.

adeyanju-call-on-tinubu-to-sack-Betta-Edu

Deji Adeyanju, wey be known human rights activist, don call on President Bola Tinubu say make e sack di Minister of Humanitarian Affairs and Poverty Alleviation, Betta Edu if dem find am guilty of financial misappropriation.

For di statement wey im sign, Adeyanju tok say Tinubu suppose make sure say dem do transparent and independent investigation into di palava.

Edu bin dey face serious yabis after one memo show face wey she direct di Accountant-General of di Federation, Oluwatoyin Madein, say make e transfer N585.2 million enta one private account wey belong to one Oniyelu Bridget, wey di Ministry claim say e dey serve as the Project Accountant, Grants for Vulnerable Groups.

Di minister talk say dem follow due process for di payment. But di Accountant-General of di Federation, Oluwatoyin Madein get different opinion.

Adeyanju wey be convener of Concerned Nigerians, wey respond to di mata, hail di Accountant-General of di Federation. Hin hail for her strong mind as she no gree to grant di request by Edu.

 

FOR MORE NEWS: “My return to APC no go cause wahala” – Abe

 

E tok say, “This action wey di Accountant-General take dey follow Chapter Seven, Section 713 of Nigeria’s Financial Regulations 2009. Di place talk say make pesin no put personal money enta government bank account. Also, make public money no enta private account.

“I salute di Accountant-General sake of her strong mind to maintain accountability and transparency for di management of public money.

“Her refusal to gree with di improper and illegal request by di Minister of Humanitarian Affairs show say she get integrity. Also, she dey follow rule of law. And by following di Financial Regulations, she don set good example wey oda public officials suppose follow.

You fit go read di tori know why Adeyanju call on Tinubu to sack Betta Edu..READ MORE