fbpx
September 29, 2024

“Di problem for Nigeria dey unbearable” -Actress Mary Njoku don cry out

mary-njoku-nigeria-dey-unbearable

Co-founder of Iroko Tv cum Nollywood actress, Mary Njoku don lament over di situation of things for di country, she yarn say Nigeria dey unbearable now. As She enter her Instagram page last night, Mary ask her fans question shey weda dem dey awake because di wahala for di country no allow sleep come her eyes, she yarn say di problems just dey increase everyday. Also, for inside di post,  She ask her fans say how dem dey cope with di economic downturn.

Mary mention how fuel scarcity still dey for di county, with poor security, lack of cash flow and other plenty wahala wey di country dey face.

FOR MORE NEWS: “Why I dey alway fight pipo online” – Singer, Portable don open up

“WHO DEY AWAKE?

MARY NJOKU YARN SAY DI PROBLEM FOR NIGERIA DEY UNBEARABLE.

NO MONEY. NO FUEL. NO SECURITY. NOTHING!!

HOW UNA DEY COPING?
THE SITUATION DON CLEAR SLEEP FOR MY EYES”.

No be di first time wey di founder of ROK studios go come outside tok about di country predicament.

You fit go read di full tori…READ MORE