fbpx
September 28, 2024

Yul Edochie first wife, May, don file N500m lawsuit against Sarah Martins over photoshop

May Yul-Edochie don issue notice of intention to file N500m lawsuit against Sarah Martins because she photoshop her family Christmas photo of herself and her children, and she  include her husband new wife Judy Austin.

Remember say for December 2022, May share photo of herself and her children for Instagram , and Sarah Chukwukere Martins tkon carry di original photo edit am to include Yul Edochie and hin new family.

Taking to her Instagram page, May share di legal documents wey her lawyer don filed, and e state say Sarah edited photo show hin client “as part of a polygamous family in which she be co-wife”, this na something wey May don tok several times say she no wan dey part of.

Also, di document state say di YouTube channel wey Daddy Freeze host on December 27, Sarah, be guest for di show. Inside di show, she make some allegations say May fail for her duties as a wife to Yul and this na hin make Judy be hin second wife.

FOR MORE NEWS: “Forever grateful” – Singer 2Baba express lifetime gratitude to RMD, and hin respond

Di documents demand say make Sarah Chukwukere apologize and to May and make she take back those publications and photoshop or dem go start lawsuit against her and dem go demand damages of not less than Five Hundred Million Naira.

For di caption of di post, May yarn Say e no make sense as Sarah just dey tok anyhow about person wey she no even know.

On top that one, she yarn say she bin get peaceful, joyful and loving family. Infact, despite di other things wey she dey manage, she dey always make sure say she build beautiful home for her famiy.

May tok say that kain act dey unacceptable to her. She still tok say her legal team go dey cheerful to dine with anybody wey no stop character assassination or slanderous publications for di court of law.”

You fit go read di full tori…READ MORE