fbpx
May 20, 2024

Cancer scare: Why we ban Indomie noodles —NAFDAC

nafdac-go-sample-indomie-noodles

Di National Agency for Food, Drug Administration and Control, NAFDAC, yarn say dem go start to sample Indomie noodles, including di seasoning, from di production facilities.

Dis matter dey coming on di heels of di indomie noodles by Taiwan and Malaysian authorities, follow di discovery of ethylene oxide, a cancer-causing agent.

Also, as dem announce di statement, di Director-General of di agency, Prof. Mojisola Adeyeye, wey explain say di compound of interest na ethylene oxide yarn say already, di Director of di Food Lab Services Directorate don start to work on di methodology for di analysis.

 

FOR MORE NEWS: Actor Jared Leto dress like cat go di 2023 Met Gala

 

However, she promise say Nigerians go dey get update on di outcomes of di investigation.

According to di World Health Organisation, WHO, ethylene oxide na colourless, highly reactive and flammable gas wey dem dey use as intermediate for di production of different chemicals.

WHO, innside report, yarn say findings from animal investigations, test systems, and epidemiological findings suggest an increase of human cancer.

You fit go read di tori, NAFDAC go soon start to sample Indomie noodles…READ MORE