fbpx
May 18, 2024

NAFDAC don lock Abuja shop because dem sell unapproved stimulants

nafdac-lock-two-shops-for-abuja

Di National Agency for Food and Drug Administration and Control NAFDAC on Wednesday for Abuja lock two shops. Dis na for claims of selling unapproved products to Nigerians.

Zuba Central motor park and Utako main market na hin di shops dey located.

Also, di News Agency of Nigeria (NAN) report say some of di unregistered products wey be aphrodisiacs na: “Hajiya Ayesha Snuff, AK47, Bulletproof, and Hajiya Aysha Maisanda.

Mr Tamanuwa Baba, Deputy Director, investigation and Enforcement directorate, NAFDAC, yarn say di operation follow intelligence reports wey dem receive about di shops.

FOR MORE NEWS: Vice president-elect, Kashim Shettima don react as hin supporters die inside fatal accident

According to di Deputy, di products na boost sexual performance and dem tok say some of dem dey manufactured for Ghana.

“NAFDAC laboratory analysis show say these products contain chemical substance called Pyridine wey dey potentially harmful to di human body.

Baba yarn say di agency don charge di sales representative for di Zuba shop. Dem go wait for when di owner of di shop go return from hin journey.

Also, hin yarn say dem discover similar sets of products for shop wey dey Utako. However, NAFDAC don lock di Abuja shops.

You fit go read di tori…READ MORE