fbpx
December 22, 2024

Madam rest, you dey everywhere – Netizens don drag Uche Ogbodo over comment on N20M gift from Ned Nwoko to Halima Abubakar

netizens-drag-uche-ogbodo

Some social media Netizens don drag actress Uche Ogbodo after she drop one harmless comment under di page of Halima Abubakar.

 

uche ogbodo

During di late hours of yesterday, actress Halima Abubakar enter her Instagram page to express her gratitude to di couple; Regina Daniels and her husband, Ned Nwoko for di N20 million gift.

FOR MORE NEWS: “Your life no go ever be di same” – Cubana Chief Priest don pledges to sponsor Yusuf Alabi through university

Na di thing wey she tok be this,

“Good morning to everyone wey dey follow this painful journey I want make una rush thank them for me. Say a prayer to them
@regina.daniels and her husband with changing my smile. Mrs. Regina, Na angel you be. may Allah be with you anytime…you dey young but full of wisdom.. your mama raise you well. An amazing husband. I wish you massive success ahead as a senator. Clearing over 20m plus no easy. Big man no be by mouth.”

Reacting to the post of Halima, Uche Ogbodo write, “God bless them”.

However, netizens don drag di Uche Ogbodo for commenting on Halima Abubakar post but remain silent during her predicament.

To see di banter between di actress and some netizens, you fit go see di full gist…READ MORE