fbpx
June 26, 2024

Coup: Niger military junta don form new government

niger-form-new-government

Di military leaders for di Republic of Niger wey bin seize power for coup in di month of July, don form new government, according to a decree on national television on Thursday.

Niger Prime Minister Ali Mahaman Lamine Zeine go lead di 21-member government, with generals from di new military governing council heading di defence and interior ministries.

Meanwhile, top diplomats from di United Nations, African Union, and di Economic Community of West African States on Thursday (today) go storm Abuja, di nation capital, to take major decisions for Extraordinary Summit on political development for di Niger Republic.

Remember say di Niger military junta bin disconnect diplomatic ties with Nigeria after di ECOWAS envoy wey dem send go di kontri to broker peace bin fail to achieve di result.

Last month, a military junta bin overturn Niger democratically elected President, Mohamed Bazoum.

Today, tension still continued to mount for di West African region.

You fit go read di tori, Niger don form new government…READ MORE