fbpx
May 20, 2024

Nigerian Striking Resident Doctors Don Suspend Planned Nationwide Protests

resident-doctors-suspend-protest

Di Nigerian Association of Resident Doctors don suspend dia planned nationwide protest after closed-door meeting with principal officers of di senate.

On Tuesday, di government beg di striking resident doctors say make dem postpone dia planned nationwide protest and make dem stop di ongoing strike for di sake of Nigerians wey dey die inside hospitals across di kontri.

Di Permanent Secretary, Federal Ministry of Labour and Employment, Daju Kachallom, wey dey try negotiate with di doctors on behalf of government make di appeal for Abuja when she address journalists for di ministry’s headquarters.

Daju beg di NARD members make dem no allow more Nigerians die because of dia absence for hospitals.

 

FOR MORE NEWS: Coup: ECOWAS don impose more sanctions on Niger

 

However, di President of NARD, Emeka Orji, yarn say di Resident Doctors don suspend di planned nationwide protest, and hin note am say dem go review everything in di next 72 hours.

Di striking doctors bin plan to start di daily peaceful protests, starting from Wednesday, if di government fail to meet dia demands.

In addition, dis decision follow di directive by di government to Chief Medical Directors and Medical Directors of federal tertiary hospitals to start enforcement of di“no work, no pay” policy against di striking doctors.

Di doctors start indefinite industrial action on July 26, following di failure of di government to meet dia demands.

You fit go read di rori …READ MORE