fbpx
December 22, 2024

Nigerian soldiers enter Lagos road, beat LASTMA officials

nigerian-soldiers-attack-lastma

Some Nigerian soldiers on Monday, August 14, 2023 attack some officials of di Lagos State Traffic Management Authority LASTMA.

Di sad incident happen for di Ojota area of Lagos state.

Based on how di tori take be, soldiers bin attack di LASTMA officials with weapons. On top dat beating, di soldiers just dey throw  curse and abuse to dem.

Recall say some days ago, one LASTMA official bin assault soldier inside commercial vehicle wey dey popularly known as ‘Danfo’ for di Ketu area of di state.

Di viral video on top social media capture di official as hin bin dey tok to di soldier wey sit down jejely inside di commercial bus with harsh tone, over unknown issue. Di soldier wey don start to vex follow reply am with insults.

 

FOR MORE NEWS: Deby Oscar raise alarm as her sister abusive ex-husband ready to remarry for di 3rd time

 

However, before person know wetin dey happy, di matter don serious well well. As di officer come down from di vehicle, hin attack di LASTMA official.

 Di soldiers wey video capture today as dem dey attack di LASTMA officials come to retaliate on behalf of di soldier.

You fit go read di tori watch di video join see as Nigerian soldiers attack LASTMA…READ MORE