“You are shameless” – Nigerians drag Yul Edochie
Some Nigerians don gather for Yul Edochie comment space to drag am enter mud for posting Sarah Martins on top hin Facebook.
Yul Edochie enter hin Instagram to congratulate Sarah Martins, di best friend of hin second wife, Judy Austin, on receiving NAFDAC approval to market her goods.
However, e be like say Yul Edochie message no sit down well with most fans and followers, wey don enter di comment area to slam Yul Edochie.
Also, some of hin admirers bin dey disappointed because hin post woman on top hin Facebook profile wey dey always abuse hin first wife, May Edochie.
FOR MORE NEWS: “Love like no other”- Patience Ozokwo share rare photos with lookalike daughter
Read some comments below.
Mavisgoodlife: “What exactly did your wife May do to you that you hate her this much with passion??
Usunella: “Unpon all the insult and disgrace make this Sarah don give your first wife for Facebook you still dey post her for your page na wa o , this is not ordinary.”Queen Ivy: “Senseless man! Have mercy on your daughter who is trying to use social media right.”.
In addition, dis matter don make pipo think say no be ordinary.
You fit go read di tori see as Nigerians drag Yul Edochie…READ MORE