fbpx
May 18, 2024

Salary increase: Tinubu dey make fake promises — NLC

nlc-express-worry-over-promises

Di Nigeria Labour Congress NLC don express worry over Federal Government promises to dispense wage award to workers since di removal of petrol subsidy for Naija.

Mr Joe Ajaero, di NLC President tok dis one inside statement as hin dey react di President Bola Tinubu speech on Tuesday for Abuja.

Di statement dey titled, “President Bola Ahmed Tinubu Speech not the Silver Bullet that Nigerians expected”.

Ajaero tok say di president statement on working with Organised Labour to review di national minimum wage no dey di same with wetin dey happen since di removal of petrol subsidy.

 

FOR MORE NEWS:Tinubu attack hardship with N500bn palliatives

 

According to Ajaero,  di claims of interventions by di Federal Government through palliatives, loans and conditional grants to poor Nigerians, big manufacturing concerns and small businesses and provision of CNG buses remain as promises!

According to di NLC president, Nigerians dey used to such promises wey no go ever produce any verifiable and meaningful changes in di lives of citizens.

Also hin note am say di entire speech by Mr President bin dey completely silent on the issue of di repair of di national refineries.

In addition, hin call on di federal Government say make dem unmask those behind di looting of Nigeria commonwealth under di guise of petrol subsidy.

You fit go read di tori see why NLC express worry over promises…READ MORE