fbpx
May 16, 2024

No reconfigure BVAS, CSOs don warn INEC

no-reconfigure-bvas-csos-don-warn-inec

Coalition of Civil Society CSOs wey dey work on credible and transparent elections for Nigeria under di support of Situation Room on Tuesday don warn INEC on BVAS matter.

In addition, di warning na against di reconfiguration of di Bimodal Voter Accreditation System (BVAS).

Di Coalition tok dia position inside statement wey dey signed by di Convener, Ms. Ene Obi and her counterparts.

However, di Coalition maintain say dat kain development go make pipo question di credibility and di integrity and conduct of di 2023 general elections.

Also, as CSOs dey worry about di reports wey indicate say di BVAS need to dey reconfigured, dem don warn INEC. However, di governorship elections dey planned to hold on Saturday March, 11.

FOR MORE NEWS: INEC: reset of BVAS na must for governorship poll

According to di statement, di Nigeria Civil Society Situation Room (Situation Room) dey  concerned about di question of preservation. Dem dey tok about di data from di Presidential and National Assembly elections of 25th February 2023.

Also,di situation Room go like di Independent National Electoral Commission (INEC) to clarify to di public how dem plan to ensure say di data wey dey inside di Bimodal Voter Accreditation System (BVAS). Dis na to make sure say di data wey dem use for di election go dey preserved for use for di review and audit of di elections.

You fit go read di full tori…READ MORE