fbpx
May 14, 2024

Nobody fit stop Tinubu – Sultan of Sokoto

nobody-fit-stop-tinubu-inauguration

Di Sultan of Sokoto, Alhaji Muhammadu Sa’ad Abubakar don yarn say nothing fit stop di inauguration of di President-elect, Bola Tinubu on May 29.

Abubakar reveal di matter as hin advise Nigerians make dem pray for Tinubu administration to succeed.

He tok all dis one for roundtable engagement with traditional and religious rulers wey bin dey organized by di World Bank on Wednesday for Abuja.

 

FOR MORE NEWS: INEC no agree with Peter Obi request to televise election tribunal

 

Als, hin yarn ay change must come because in the next few days or weeks new government go come. And hin ask say wetin we fit contribute to that government to stabilize?

In addition, he yarn say Whether anybody like am or not,  di inauguration must take place, new government go come on May 29.

Hin charge Nigerians say make dem dey united and work towards ensuring equity and justice.

You fit go read di tori as Sultan of Sokoto yarn say nothing fit stop Tinubu inauguration…READ MORE