fbpx
December 22, 2024

Netizens reacts as skit maker, Nons Miraj get Botox nose job

nons-miraj-don-undergo-botox-nose-job

Nigerian skit maker and brand influencer, Chinonso Ukah, wey dey known as Nons Miraj, recently undergo Botox nose job to achieve  pointed nose.

Botox nose job na non-surgical cosmetic treatment wey  involve injecting Botox into di nose to reshape am.

Videos  wey show di content creator as she dey undergo di procedure so dat she go get pointy nose dey shared online and e don cause reactions from social media users.

Inside di footage, di 26-year-old do face like say di procedure dey pain her as di aesthetician injects her nostrils to make them smaller and narrower.

After di video go viral, netizens rush go di comment section to share dia thoughts on di procedure and question di need for nose job.

A while ago, Nigerian fashion blogger, Laura Ikeji come under heavy criticism from social media users. Dis na after she return to her surgeon for nose job.

You fit remember say in April 2021, Laura reveal say she finally do cosmetic surgery on her nose. And na to make am more pointy. Also she yarn say pipo bin dey take her do yeye because of di big nose wey she bin get.

You fit go read di tori see reactions on di nose job wey Nons Miraj undergo…READ MORE