fbpx
September 28, 2024

Presidential election tribunal: “Make una Prepare for shocking, miracle outcome” – Ohanaeze to Nigerians

Ohanaeze Ndigbo, di apex Igbo socio-cultural organization, advise Nigerians make dem prepare for “miracles or shocking” outcomes from PEPT.

Ohanaeze Ndigbo, di apex Igbo socio-cultural organization, advise Nigerians make dem prepare dem sef for potential “miracles or shocking” outcomes from di Presidential Election Petition Tribunal, PEPT.

As hin dey express hin concerns over di public expectations, Ohanaeze point out di disappointment wey pipo experience after di 2023 presidential election.

Also, di body give warning say na di same scenario fit unfold following di tribunal verdict.

 

FOR MORE NEWS: Naira don near N1000/1$, pipo dey worry, and CBN dey investigate

 

A statement by Ohanaeze factional Secretary-General, Okechukwu Isiguzoro, yarn say di Ohanaeze Ndigbo acknowledge di widespread optimism wey follow di 2023 election due to di new electoral laws and di Independent National Electoral Commission (INEC) assurance of a credible, free, and fair process.

Also, hin yarn say di introduction of electronic transmission of votes bin dey expected to enhance transparency and accountability. And e suppose give citizens confidence for di electoral system. However, di election outcome make plenty Nigerians discouraged.

You fit go read di tori see all of Ohanaeze Ndigbo advise to Nigerians…READ MORE