fbpx
May 9, 2024

Naira don near N1000/1$, pipo dey worry, and CBN dey investigate

naija-currency-experience-free-fall

Naija currency don continue to experience free-fall against di Dollar two months after Central Bank of Nigeria floating of Naira, dis na decision wey don make matter worse, and e don affect Africa largest economy.

From 14 June, when CBN liberalize di forex market, till date, di kontri currency continue to decrease against Dollar from N750/$1 for parallel market wey pipo know as a black market to N950/$1 on Monday, August 14, 2023.

As things be now, di matter don make pipo dey worry. Also, di gap between di official window and di parallel market dey wide with a differential of N181, and dat one defeat di essence of CBN floating of  Naira.

Di ongoing investigation of apex bank by one special investigator, Jim Obazee, wey bin dey appointed by President Bola Ahmed, fit don make matter worse pass as e dey before, an na wetin follow cause di depreciation of Naira, according to experts wey sabi things for that sector.

 

FOR MORE NEWS: (BREAKING) Forex: CBN don make move to stop naira free fall

 

On Monday, di president of di Association of Bureau De Change Operators of Nigeria (ABCON), Aminu Gwadabe yarn say make pipo no blame dia members for di ongoing crisis for di forex market.

Hin blame di plenty unlicensed online platforms wey dey operate different jurisdictions without standardized regulations wey capture diaspora remittances and dat one deny di official market.

According to am, di recent happenings for di sector don bring di need for CBN to allow dia members arrest agents of diaspora remittances. Dis na so dat dem go fit block loopholes and stop di forex crisis.

You fit go read di tori see wetin CBN tok as Naija currency dey experience free-fall..READ MORE