fbpx
December 22, 2024

Oil spillage: Four Ogoni Farmers go receive $16m as compensation from Shell

Shell-oil-spill

Four Nigerian farmers and dia villages neva collect Shell $16 million (£13m) as compensation for di damage wey oil spills cause

Di compensation come after di Oil company Shell and di Friends of di Earth, CSO reach an agreement.

Remember say di Nigerian oil industry bin don dey suffer plenty challenges following environmental damages wey  oil hosting communities experience.

FOR MORE NEWS: Oga no waste your time to dey campaign for Tinubu, PDP clear Buhari

From 2004 to 2007, di oil spill case continue, and di payout follow decision by Dutch court say make dem no hold di Nigerian branch of Shell responsible for di environmental damage.

Di campaigners hail di 2021 court decision as di first time wey multinational go legally dey responsible for wetin subsidiary do.

“We appreciate this compensation; we can build up our community again. We can start to re-invest in our living environment,” Eric Dooh, di son of one of di farmers wey launch di case in 2008 alongside di Dutch branch of Friends of di Earth, na hin talk this one.

You go like go read di full tori…READ MORE