fbpx
December 23, 2024

Reno Omokri don call out Obi as Obidients attack Pastor Adeboye online

omokri-don-call-out-obi

A public affairs commentator, Reno Omokri, don call out di presidential candidate of di Labour Party, Peter Obi. Hin accuse am am of hin failure to call hin followers, known as Obidients, to order.

Omokri yarn say Obi supporters don insult all Nigerian icons, including di General Overseer of di Redeemed Christian Church of God, Pastor Enoch Adeboye.

Report bin tok say Pastor Adeboye on Sunday express optimism say di president-elect, Bola Tinubu, go fix Nigeria with di help of God.

Adeboye, wey bin dey represented by hin Special Assistant, Pastor Dele Balogun, tok dis on for di monthly Thanksgiving service for di RCCG Headquarters in Ebute-Metta.

But, Obi supporters feel offended by di statement wey dey credited to Adeboye, and dem call am names on top different social media platforms.

You got remember say Obi supporters bin drag Adeboye during di build-up to di election. Dat time, dem accuse an say hin no gree declare open support for di former Anambra Governor.

Plenty of dem believe say di Christian leader fit dey secretly support Tinubu Muslim-Muslim ticket because di incoming First Lady na pastor for hin church.

 

FOR MORE NEWS: Federation Cup: Ikorodu City boss target victory against Kwara United

 

Omokri express sadness as Obi dey fear to publicly call hin supporters to order. Hin yarn say Obi prefer to meet di insulted leaders privately to say one thing indoors and another thing outside.

Also, hin lament say di Obidients don forget history and dem dey “make offensive images, songs, skits, and remarks against Pastor Adeboye wey get millions of loyal followers for Nigeria.

You fit go read di tori see wetin happen as Omokri don call out Peter Obi…READ MORE