fbpx
May 18, 2024

JAMB vs Mmesoma controversy don show say 2023 elections divide Nigeria – Omokri

omokri-react-to-mmesoma-controversy

Reno Omokri, wey be socio-political activist, don react to di controversy wey surround di Joint Admission and Matriculation Board, JAMB, result of Ejikeme Mmesoma.

Omokri yarn say di controversy wey surround Mmesoma JAMB result don show say di 2023 general elections don divide Nigeria.

He yarn say ethnic and religious sentiments over Mmesoma matter no dey helpful.

According to Omokri: “Di JAMB don give dia verdict. If anybody get concrete evidence, make dem come out with concrete proof, instead of ethnic and religious sentiments over a pure technical matter because e no go help anybody.

 

FOR MORE NEWS: Fuel subsidy removal: ‘N400bn savings’ don raise questions

 

Also, hin tok say Nigeria already dey divided from the #NigerianElections2023. So, no need to raise insinuation wey go further divide di Kontri.

Hin yarn say instead of speculating or making dis matter about ethnicity and bias against certain parts of Nigeria, make pipo hold your peace until di investigative panel set up by di Anambra State Government establish di facts

Also, hin yarn say di Anambra State government and non-governmental bodies wey dey concerned suppose FIRST verify from JAMB DIRECTLY by writing them letter before relying on social media reports.

You fit go read di tori see as Omokri react to Mmesoma controversy…READ MORE