fbpx
May 4, 2024

BREAKING: Ex-Governor Ortom present himself to EFCC for Makurdi

ortom-present-himself-to-efcc

Former Governor of Benue State, Samuel Ortom Tuesday morning present himself to di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC, wey dey Makurdi for questioning.

E dey gathered say di ex-governor reach di office of di anti-graft agency around 10 am with some of hin personal aides.

According to report, na di commission invite am to answer to allegations relating to hin eight years of stewardship as governor of di state.

Before di former governor bin leave office, hin promise to remain for di country for at least five months to answer any questions wey fit flow from hin eight years stewardship.

Also, hin promise to present himself before anti-graft agencies if dem invite am for questioning on any issue whatsoever.

 

FOR MORE NEWS: Tinubu don appoint Hannatu Musawa as Special Adviser on Entertainment, Culture

 

Hin follow tell hin appointees say make dem dey available for questioning if dem dey invited saying.  He tell dem say anytime wey dem dey invited by EFCC, make dem no fear to go.

In addition, hin tok say hin no be coward to run away from EFCC.

Though no official of EFCC provide any information on di visit of the former governor at di time of dis report (12:55 pm) yesterday.

You fit go read di tori as Ortom present himself to EFCC…READ MORE