IGR: Osun APC accuse Adeleke of deception, lies
Di All Progressives Congress, APC, for Osun State don accuse di Ademola Adeleke administration of run di government with a high-level deceit, lies and diversionary tactics.
Dis accusation dey come on di heels of recent claims by di current administration. Dem yarn say di state revenue dey diverted into di personal bank accounts of some revenue contractors for di Ministry of Environment.
E neva too tey wey report yarn say Governor Adeleke direct an overhaul of di revenue collection protocol. Dis na as e affect di Ministry of Environment and other agencies.
FOR MORE NEWS: Peter Obi praise Adenuga as he mark 70th birthday anniversary
Also, di Governor direct di immediate stoppage of di inherited collection model for di Ministry of Environment and Sanitation.
However, in response to di Governor directive, di Osun Internal Revenue Service, OIRS, through di acting Chairman, Abiodun Olaitan follow warn revenue consultants. Hin tell di pipo wey dey work with di state government say make dem stop all forms of fraudulent acts.
In addition, di Osun APC, through statement by di acting Chairman, Tajudeen Lawal, describe di claims by di state government as a watery alibi. Also, hin add say those pipo wey dey involved in di act na part of Adeleke associates.
You fit go read di tori as Osun APC accuse di Ademola Adeleke administration…READ MORE